Iya Basira


This na one buka wey I dey like to go
The food sweet sote e go make your mind blow, day and night iya bas how she do am I no know
They think say na jazz, my broad no be so

Chorus:
People people make una come o
Iya basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place
People People make una come o
Iya basira e go kill me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food

Long throat na food go kill u-no be so, I say na food go kill u – oga mi no be so

Wettin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday,
Na so I reach there but Sunday e don high on beer luckily for me him junior broad eye e clear,
He say make we stroll to the area, little did I knw that I was strolling to my burial
Right there were oshodi bus dey load was a little buka close to the mainroad
I laf when e pass the door, e tell me say hin name na Iya bas for short but I bow when e order,
Iwesiatewa, ero mm purewater not even mineral I come gree say I go manage to chop am
Before I realize I dey order 2nd round, 3rd round, 4th round, I never still stop
Wetting iya basira e give me chop?
Repeat chorus

Long throat, na food go kill u, na food go kill u

Oga mi, u think say na play when I say na the way wey I dey, e no day ok
Wetting be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy iya basira rice
Even on my girlfriend birthday when she dey wait make I take am to ocean view,
I no know when I pass the place, the only thing wey dey my mind na Iya basira palm oil stew
Ah! Kilon kilon shele shele me I never see this kind juju, telle telle
All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya basira na……
I sure say still I go go there go sidon, order my first round move
To 2nd round, 3rd round 4th round I no dey ever stop wetting iya basira come give me chop?
Repeat chorus

Officer abeggi follow me to the palce, everybody don telli me I dey craze
My girlfriend don leave me my moda no gree see me my paddy ah! Iya basira e don kill me (x2)
Oya people, people make una stop officer e don come
Where the woman, hin dey inside, (oga I dey come)
Woman na wetting u dey give people chop wey dey cause all this wahala casala, oya make we talk
Oga sir true to God, nothing wey I dey put for the food wey I dey cook, na God dey make am good
Na which kind talk be that, say na God dey cook the food abi u think say I be fool no be juju u dey put,
Infact I dey suspect say na…u wash put sote people dey queue come dey rush for your stew,
Well to confirm am bring am make I chop small Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw
Chaii correct this food sweet no be small shey una no go vex if I still order for more
Officer no worry na the food be this
Oya people, people make una go, case dismiss

Repeat chorus 2 times







Captcha
Widget
Das Lied von Styl-Plus wird Ihnen von Lyrics-Keeper angeboten. Widget kann als Karaoke zum Lied Styl-Plus Iya Basira benutzt werden, wenn Sie die Moglichkeit haben, den Backing Track herunterzuladen. Fur einige Kompositionen ist die richtige Ubersetzung des Liedes zuganglich. Hier konnen Sie auch die Ubersetzung des Liedes herunterladen. Wir bemuhen uns, den Text zum Lied moglichst genau zu machen, deswegen bitten wir Sie um eine Mitteilung, falls etwas im Text zum Lied korrigiert werden muss. Wenn Sie das Lied Styl-Plus Iya Basira kostenlos im MP3-Format herunterladen mochten, besuchen Sie bitte einen von unseren Musiksponsoren.